lmaoo.. Where Are the Celebs on this Blog?! Ed Dreamz, Obinna, Flacko, Nono, Una Get Mail
Y'all will find the author of this hilarious email titled 'Weekend Shoutouts'' at the end of the post. It was sent in last night. Enjoy....
Hello Dearest Dear, Lady Laila, A very serene Evening to you. how have you been?
How is your Family?
I want you to post my shoutouts to fellow Blog Readers.
.
Here it is:
.
.
Let me first of all Go down low for God himself for giving me the greatest gift which is
life, for without it lailasblog.com will be out of my reach.
.
I doff my ugly cowboy hat in respect of the lady of the moment, the agbdagburu and CEO of lailasblog and company lols ☺☺ ☺.
I raise my right hand with my two first finger to the TILB STAFF 1,2,3,4 if e reach five abeg make una share am.
.
Let me now meet the main celebrities,
The people that celebrate everyday through TILB,
The people that I have cheated from the onset of my coming here on TILB,
I have cheated on them in the sense that I have been basking in the euphoria of their comedic prowess and strength without showing appreciation.(Too Bad of me)
And who are these celebrities?
Nono Blessdm: O boy I no no the tribe wey your name represent but something dey tell me say na Nonso, your hilarious comments which sometimes don't exceed one sentence is immeasurably hilarious. You dey try bro, I raise my arm for you.
.
Oga Ed Dreamz wey dey always relax for Jupiter, one question for you
abeg no vex, you be DJ abi you dey work for Musiic 212 ni? Because e
dey baffle me say everytime you comment you dey always dey Jupiter dey
shuffle music.
I like your way shaa.but you don too stay for there, try shift go Mars
or Saturn I go there last year better groove yakpa for there. Not
withstanding, chop knuckle my Brother I love your spirit.
.
Oluwa Obinna Azubuuko, Obi nwanna, Obi fire, Nwanne Ka ije gi?
Your name dey remember me those days in university, one of my Guy him
name na Obinna Azubike, though say d Guy dey Jail now. But no worry,
dem go release am this year. Him go carry drug wey pass am wan enter
China. Hehehheheh. Bro I hail you from my End.
.
Lord Flacko, E don Tey oo, how Okija your wife na? Hehehehhe. She don born?
You tell me say you go call me last week say e get something wey she
do you wey u no like, I no see you, I no come see your call, hope say
una don settle?
Anyhow shaa, Tell am say I dey greet.
Lord F abeg no vex na Joke sha.
I love your commentaries man.
.
Derrick chidumebi O boy this your black singlet don Tey oo, since
2010, anyway na original shaa.
I see you as you dey laugh bcs say on Asian Guy name na phuc dat
bitch, Hmmm O boy your name and the guy name na almost d same oo,
check am na, if no be because of the "err" wey dey for "derrick" e for
be Dick oo. And if no be d "chi" wey dey chidumebi e for be dumebi
alone ooo, so if you plus and minus them na "dick Dumebi" you go get
ooo, and you sabi pass me wetin e mean for hood. hehehhe.
Bro I greet you plenty.
.
Chief Austin Uche, where are you?
Clap for yourslef.
Clap again.
Ehen! You know why you clap?
You no know abi?
I just dey see how girls and ladies, you know them,as dem dey crush on
you. O boy you go soon delcare your assets make I know wetin dey shark
dem. Abi love spell don enter Social Media?
And the thing be say you no dey craze for them as dem dey craze for
you, abi you sure say Bisi alimi no be your paddy pa?
Hehehheheh abeg no vex,na weekend we dey.i catwalk for you bro.
.
Heheheheheheh, so where are they?
The TILB temptresses,
The reasons why Ed'Dreams still dey Jupiter,
The reason why Austine, NONo, Lord Fuck sorry flacko, Obinna nwanna etc
say na for TILB dem go dey till Nigeria go start dey build house inside water.
In the persons of :
Esther Amaku, Madam How far?
See as your teeth complete like my own.
You be igbo abi na Edo?
Make e no be Edo o because eh (make I reserve my comment)
Well before I forget Derrick say make I greet you.
Weldone Sister.
.
Zombie Huntress, Nwa ke way?
Don't bother telling me your tribe bcs I no say na Edo, dem no dey use
Hunting play, hunting for Zombies, someone's husband, money, humanbeing,
etc.
But I like you sha, you know why?
I go tell you when we see nextweek for our normal joint. hope say u go
still come?
No hard feelings my Dear @Huntress keep your humble self Goin 1love.
.
Lisa Peters, I no know oo. But e be like say u be my facebook friend.
Anyhow shaa. MY sister you dey try well well dey seduce dem Boiz here.
Collect 5 sister!
.
Elizabeth Nwannkwo, Hmm see as u fine like indomie instant Noodles,
Na Brazilian hair be that?
I like you jare.
.
Carina Jacobs, see as you fresh like Onions, see as you sample your
teeth like Derenle Edun.
I dey Greet you from my End.
.
Diamond, you don marry?
See as you fair like toothPick.
.
Barong Nku, this your Lipstick na Kim K product?
The thing make sense shaa.
Fine Girl,Fine pimples.. enjoy sswdy.
.
Damsel, How this Xmass go be na.
Make I come?
.
Ogechi Juliet.
Please would you do me the Honor of being my Bride?
See as you set like Egg Roll.
Fine geh..
.
Lastly to the Oga/Madam anonymous(es)
I dey greet una too.
“Being in the company of great group of folks enhances one’s
ability,“Before I am deprived of your amazing company knowingly or
otherwise I would like to let you guys know that you matter to me more
than have ever said or you have ever perceived.” thank you for helping
me in a way best known to me and cooperating with my spirit...
Long Live us, Long Live Laila, Long Live TILB.
Yours sincerely
Hon. Mr Abel Valentine Nnachebem.MEET ABEL: