Esther Imaku Finally Admitted to a Mental Hospital After Devastating Breakup With K-Club
This is strictly a fun post. People with an impotent sense of humor need to exit now.
Something fishy is up on this blog. Ever since K-club dumped Esther, She has been on a downward spiral. The heartbreak and loneliness drove her into doing drugs and sniffing glue. She was finally Lamar-Odomized last week when she ODed. To make matters worse, Mr K-leg is yet to visit her at the psychiatric ward despite being responsible for her predicament.
Imagine my surprise when, I got a mail this morning from Esther. From the content of the letter, Its obvious that the damage done by Mr. K-leg is indeed serious.
Esther's mail after the cut. But i warn you, its full of deranged facts
Hello Laila''s Peoples
How you doing?family and work.Kindly help me post this hun....My people..How Una dey?.Aproko gist volume 2 don land again oooo.
The matter for this week be as he get small.ehn.....Who say Austin no get coded talent never jam am face to face.
Abi u no see d kian style wey he use for Pamela interview?
O ya bring ur ear make I start. ......The guy man just start with sweetie. ..but when he find out say bae no dey on sale again. ..He just start to call her name in full....Pamela Okonne....Lol.Una remember when Pamela say some Nigerian men are romantic?
Austin be like...So many guys will love you for what you just said lol...
Too bad you aren't searching. ..sorry guys....Bros , next time. ..Just say sorry Austin. ....especially when ur crush no dey on sale again. ..No add other guys join body.LolOmo....God is good oooooo
Imagine that moment Eefy (Epic Bum)made kclub order for shirt and trousers in a fast food instead of pizza and Made our Honorable SouthEastern Holla...Maximum Respect Eefy immediately he saw the good work of God.Hmmmmm...who no like better thing.Flacko be like...I just wish I can have a private discussion with the lady in my bedroom and Queeneth London be like....ehn? See who dey talk.As Queeneth London still dey beef flacko. ..na him flacko eye just waka go Queeneth London comment too.Queeneth be like....I don't fink her face is ugly! She z good looking, 9ce bum btw and flacko was like....U sure say that comment come from ur mind?
U should code what I mean by dat....No b my mouth go talk all.Una remember d post of pipu wey dey look 4 life partner. ...Oluwabunmi mary sef come carry her own come...U hear something like ..Am not a relationship kind of gurl. ..that statement alone provoke Chris.Chris be like....seriously? What then is she looking for. .Hit and Run?Before Chris go cool temper. .bros kclub don announce say him dey go fbk go search for bae profile (Dat na him area of specialization tho).
At the same time, kclub dey ask Missy Bee...If she dey available. .LolNonoristic Bobo, just cry out from nowhere say. ..Kclub please do and get married abeg
No girl dey look my side again because of you.Nono, na so you funny? Abegi. ..If girl no dey look ur side..how u take sabi say Appleberry sick and cum still ask us to beg her 4 you. (U see tribal mark 4 we eye? Guy park well jawe).Big mama solly. .nkebonita say make you warn all them sugar mummy to stay away from her Jupiter and shaving stick ooooo. She no dey joke with those two living things at all.Amanda the shoki bae...we sight u. ..Since you are single. ..Obinna Azubuko is ready to mingle.TILB Staff. ..b like Abiodun has done it again ooooo. ..And I was expecting to see something like. ...I am now a Pass Out....Thanks U God. ..since him be Camp before. .Only to see say na same post he dey refer to....Guy, abeg stop to dey take Orijin inside sun...LolFinally my special pipu...As I dey waka go bed jeje, na him I see one post wey burst my brain with laff. ...I laff ehn...water comot my eye. Una suppose don Jasi nau.The post on.....Colour of your underwear + the last thing you ate =your band name. ....Hehehe. ..U go fear comments.Na so I see lailalicious baby band name as Red Jollof Rice at exactly 9:01pm wey she put the post dere....Madam...are you kidding me? Your band name suppose start with only Naked since the beginning of this week go reach Sunday your Anniversary(Nov 15th).Except u are under the weather) And u must continue to maintain Naked as your band name especially 4 nite till Jesus come. ...Lol.Even a member of your team. ...Like Team laila. .was Naked Jollof Rice. .Lol.......Hmmmmmmmmmmm (d spirit is moving)Barong is always representing crossvarian...As d thing dey shark her...she just type. .Nacked fufu....but when her eye clear. .she cum type. .Naked fufu. ..Lol. .I come dey wonder weda she dey with Mr_ soul dey mistype again?
Na him Mr_SouL type him own too from nowhere as...Blue Indomiecumber.Hmmmm....food dey oooo.Oma Bella Oma. ..U no dey carry last at all....Only u get this band name. ..
Naked yam and veggie sauce. .. (we are still waiting 4 d display of ur Bum ooooo).That akward moment. ..Breeze typed. ....Black Naked Banana. ..Even Pamela's Dog Rooney b like....U can lie 4 west Africa sha....U wey dey chop tuwo.Queeneth London. ..be like Black and white padded burger.
And flacko was like....How is dat ur band name when you are here with me eating. ..Stripped Beans.Na so Chika Collins appear from nowhere type. ....Yellow Indomie with pink fried egg.....Lmao. ...Na hear you go no say someone like this bae go wear close to three jeans like Elizabeth nwankwo during Honeymoon before Oga go fit declare her Band name.....Lailalicious baby, biko kindly add this game with anything goes tomorrow so that as we dey yarn wetin Happen around us, we go come support am with Band name too....We get plenty talent and business minded people here. ..follow Pamela okonne on Instagram as The_luxury_mall. ..to oder for nice shoes and bag.Then Holla Barong for make-up, customized bags,souvenir and all kinds of latest beads.We go continue by God's grace next week. ..Still remain my humble sel
Inspector Nifemi
Now tell me. Who monitors peoples comments like this.. Esther are you a monitoring spirit? I take God Beg you. face your work. Meanwhile send your pix or you update your blogger profile so we can recognize you when you escape from the hospital.
Obi Jonathan
A web designer from Nigeria.
0 comments:
Post a Comment